Internet Palava for Naija

in #naijapidgin8 years ago (edited)

images (2).jpeg
Source

Today Tuesday my people I greet una from the house of Naijapidgin..... Remember say our contest still de on so if you never join better go join here because 10sbd de for grab and if you de loose at d moment better find way to start to de win

Today matter pain me sotay I no fit hold am again so abeg make una help me put mouth before I vex,

I no understand why naija tin too de slow and different....

Yesterday I de for Cafe de try to reg for nysc and from morning to night the network slow and people de talk say na congestion

Now the matter na say Facebook wae people de use everyday no de ever get congestion abi na bet9ja wae people de play game everytime neva get congestion

Oya tell us the strong thing wey bad internet connection don do you.

which network for Naija get the best connection

I go start from me... I believe say na GLO

Watin you think... Drop am For the comment

@mittymartz bring today tori for us

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design this avartar for our ogbonge community.

Sort:  

Glo??

I think say everybody dey complain about Glo.

Well, Glo make sense for where i dey. So i no too get wahala about network.

Issorite

De enjoy your Glo even me sef I de flex my Glo here

To me na mtn i vote for.... But for my service area here na Airtel and Glo good pass. So na Airtel bundle i dey sub.

i remember when i still dey play bet9ja, time of the game done almost start, i come get one ogbonge fixed match wey den send me, omo network come do me bad thing i know see the game bet and the betting shop to my house the Waka know be here own inside hot sun

See your life

So na bet9ja u take your data de do
Mtn sure sha but some places and location na GLO

read my comment. Not anymore it was once upon a time in my life

Airtel dat dey double-double thief on top pesin sub....you no talk correct atall bro!

Naija network don cast abeg! I no fit dey explain wetin e don do me

Babe I feel your pain jawe

I na know say you fit type pidgin ooo....
You get boyfriend.... Me I wan apply ooo

hehehe..!
which one be this again
no blockchain toasting o

I de look you de laugh and because you get banana head

Blockchain toasting is allowed right from day one

@Teamsteem and @karensuestudios

Na where you dey be d koko. I bin use Almost all the network for nails and every every don fumble Jor.

U talk better

The network de work with area and location
Like ekiti now
9mobile no de at all not even 1bar na offline you go see

If na for that NYSC mata, na normal tradition. The best time to register na midnite wen everibodi don sleep. E no finish, dem go say make u snap passport with white background like say d pesin wey design nysc website na cele member.

For the network, all of them get their own palava.
Glo make sense before but now even snail(congo meat) get speed pass.

Na etisalat be the best but dem dey use that mosquito straw wey dey draw blood to take remove ur data and e expensive too

For the contest, make una show una boi love with upvote

I salute Una

Even for midnight e no work

Snail fast pass am

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

Thanks for the r cumin around

thank you say you upvote this wonderful post

Na all network dey get problem but i dey gbadun Airtel because if dia network wan do somehow,dem go don beep you before that time say network go flunctuate so so day. As you know say MTN na everywhere you go,no place wia you go wey you no go see in network but e too get in own time wey e dey do rubbish,Glo na in i hate pass even my shit beta pass am. I no like them from here to there

This your own case different oooo

Glo na shit?

But na true na airtel de tell people but others, network go just off

Anything wey do with naija edu network always dey slow from waec to nysc na so the network dey be even if you wan try am for night na same thing.
The network wey dey sweet me well na Etisalat wey dey change go 9mobile. The only issue wey I get with them na, dey too cost. Jesu, dey be like G wagon. U fit just manage buy 1GB e no go last you reach 6days, but them dey fly like witch.

I know say all of us dey the competition but e no bad if una still just put hand vote for me. Thanks and Baba God bless every naija pidgin pikin

Hahahajah

First person for this life wae go say Etisalat good about na 9mobile

Na when person wan do better thing the network go dey do anyhow. As I wan do one business transaction for my internet banking, na so this network dey misbehave and I be dey busy that day, wey be say I can't go out go deposit for bank. E pain sotee I be wan cry, I try make I call their customer care service, that's one too ring they no pick. No be easy gbegeee oooo. That yellow network eh, Dem don show me.

Pele jawe

Just join the mtn gang.... Even if mtn go fuck up na smapl

Network for naija na cast to me o no best network for dis country all of dem na d same e get one day wey i wan send money give my sista thru mobile banking and e dey urgent na that day mtn no say ddem wan crase d thing pain me even yesterday wey i dey enjoy naijapidgin tori na that time bad network start i wish our networks fit dey stable for we country i go happy well well

O my chisos

You just turn me on as you say u like our tori but network no fit sha pra pra for Naija