MONKEY BUSINESS

in #naijapidgin8 years ago (edited)

My naija people I hail unah o.

Make I great unah Wella because e don tey small wey we yarn together for this our community, make unah no vex nah because we dey try arrange this our house as e go take better for everybody and how we go dey contribute to this our community but make unah no worry now we go dey give unah Tori everyday back to back.

imageimage
As e dey be eh.... Today we get ogbonge Tori wey we want make we for shook mouth put. As I dey yarn unah so eh another one don happen again o. Just 3weeks ago we been dey talk about moni wey snake swallow, e Neva vomit am nah him our APC gomenti don come outside with another Tori say monkey don swallow 70 million.

Abeg my country people, make I ask una this question. Abi we country don turn zoo wey animals go dey terrorise us abi moni don turn animal food?

Why be say our yeye politicians think say them fit take us play ten ten? Wetin dey even pain me be say nah one northern senator we em name nah senator adamu Dem say carry d moni put for em farm before the monkey swallow am.

Abeg wetin carry 70 million go farm before monkey come swallow am? Who get the monkey? How the monkey mouth big reach for am to swallow that kain Moni and how many hours e take am to swallow am?

This our country matter don tire me, 70 million no be beans o. E b like say this our politicians think say we no get sense, them no dey even think before them talk give us

My country people how unah take reason this matter? Wetin go fit stop this nonsense wey the dey happen? Wetin b d solution and way forward for this our country naija.

Abeg make we shook mouth put and make we no forget to make make am short.

@oliverwilliams nah him write this one for @naijapidgin

You for still join others wey love naijapidgin for Telegram

image

Avatar made by @mittymartz

Sort:  

Make i 1st hail d pple weh dey mk dis our naijapidgin community stand gidigba o,God go bless una handwork plentifully....
E don teh small wen politics mata 4 dis our 9ja start to vex me,so tey snake fit swallow #27m...now na monkey don carry #70m run....
Na cos i no dey wan listen to all d jagbajantis dem dey yan 4 our local news mk me no dey watch tv at all...na just entertainment n sports i dey watch 4 tv n no b local stations. If i wan watch movie,i either go cinema go watch or i download am 4 my fone...if i wan current unto news mata,i dey prefer to listen to foreign news on CNN or Al Jazeera...but 4 dem NTA,Channels n co,dia news na propaganda...
@naijapidgin,i hail o....

Welcome to naija of our own where every news na comedy.

Haha, nija my country, the tin wey we do do for this our nija eh, on how we begin talk am from today reach tomorrow, the tori no dy end. Na so so kasala Nd gbenge everyday. Na God go help us oh

D country wrong too much o... Mk we Sha dey manage am...

Make I no lie una, naija no fit beta pass as e b so, except say e go bad pass. Doz politicians don dey too use us play. I vote for say make we Dey go use gun shoot dis useless people 1 by 1...na blood fit cure naija wahala... blood of the cabals...

Chei

I wonder why I no see this article comment on top. Anyway, as I Don show, make I yarn my mind.

On top this matter ehn, one serious matter day under. People talk say if you day see small spirit day dance for public, no big spirit day play the drum for am. Wetin be the big spirit? No sense of accountability.

When people day country way nobody day accountable for anything, wetin you day expect? If I know say nothing for do me, I go day yarn anyhow.

Say na country way get strong institutions, all these people no go day yarn nonsense from their mouth. But they know say nothing fit happen.

If na country way day hold people responsible, at least you for hear better lie.

For example, after all of the talk nothing go happen. Life go return to normal.

Small time, rat go day drink petrol.

I don talk my own finish

My pipu I greet una with plenty salute. Dis Na topic to yarn about o.
Dis our country wake don tire me o.
Like play like plenty Naija wey b before giant of Africa don turn animal kingdom.
Na animal d swallow money now for we country.
make I tell una one thing wey una suppose know.

if the owner of house shut for e house or wear slippers enter, visitors go wan do the same tin because the owner of the house don spoil the image of e house.

our oga presido Na e startam when e come back from obodo-ibo cum say rat enter office chop document.
so Na if small rat go fit do dat kind tin y monkey wey big go carry last.
my people we country leaders wan kills us.
I don tire for the pipu and the country.
abeg who fit predict the next animal wey go swallow money?

The only thing wey I sabi be say, snake swallow money, monkey swallow money, one day one day, monkey go catch hunter. Mae dey continue to dey give us tori nah like say we mumu, dem go soon know say our mumu button don lost.

I dey tell you, nah Make we gather stand up fight make all this Tori stop.

Mata don dey ground for this countri ooo, i don dey tire for these animals wey dey swallow money up and don, naija dey untop baba loke hand

dis one come pass me o,i suspect say all dis monkey and snake na human being! e no get watin nigeria no fit do.

The mata tire me self, I no come know which Tori Dem go tell us next time

Na now i believe say our country na zoo. How monkey go take swallow a whole 70million? The story no just make sense at all. About the solution to matter and d way forward for our country, make i no lie for una, solution no just dy. No vex, bcos buhari wey we dy expect to change our situation, come make am worse. The only solution na if oyibo go fit colonize us again.

So you go prefer make we return back to slave era than this democracy wey we get so

If na wetin go make us get sense. Bcos of economy of then better pass now

The only thing i fit talk for here be say na human being of our kind dey turn into all this animal wey dey carry we money run for we country Nigeria dey turn to snake monkey and so on

Na true yarn you yarn so. Na we we dey turn into the animal. Animal wey dey swallow money where e dey shit am put?

As d tin tire you so it tire me join. I see the news come dey ask my self.. " I be like say animals don dey use money for there world.

But the one wey tire me pass nah how farm house come become bank. And how monkey come become cashier for the bank come swallow money.

Make our leaders no dey deceive us. If person wan eat money or if person eat money make he just jeje come out yan us. We go understand..

As I talk am it dey for my mouth oo. Make others yan there own.

But the tin dey pain me soteee.

@godswill

Wetin me go say be that our leader don turn corruption to zoo game. Before na snake carry 36millon now na monkey carry 70 millon for farm. Very soon na pig,rat,dog,cat go carry there own oh. How person for senate go say he go put money for farm and monkey cum carry ham. How our leader they do like this. Wetin me go say is to let our youth stand up. Make we na no take all this bullshit lie. Make we fight for our self before all animal go carry nigeria money finish.Monkeys.jpg

I salute everybody wey dey dia domot!!! When ogbenge person talk say naija na Zoo... them for we country talk say na "hate speech" Now we done dey see am for our korokoro eye.

i done see vision ooo.... make una listen wella, as animal done dey swallow moni, if your moni dey for "Union bank and First bank kukuma go commot am ooo

Elephant wey dey for first bank logo go swallow the bank soon...

Horse for union bank go carry your money run oooo

no talk say i no warn you ooo

Naija don be as e be.. na to seat-down dey look i dey look them....